0:00/???
  1. B.B.E.N.Y

From the recording B.B.E.N.Y

Lyrics

B. B. E. N. Y

I dey waka dey go my own, dey mind my business je je
One dog come comot CH: for one corner
E look me with one eye CH: for dat corner
E look me with bad eye
CH: for dat corner
E look me with red eye CH: for dat corner
Dat dog come de yap CH: for dat corner
So tay fear catch me CH: for dat corner
So tay I beging dey shake CH: for dat corner
I come think for my head

I no go run, I must pose, I must shakara, I no go hala
(CH:I no go run, I must pose, I must shakara, I no go hala) X3
I say, how fine boy like me go dey run for road bicos of dog
In front of people, ko b’oju mu rara, oro agbedo
CH: I no go run

CH: Best Bet e ni yen Best Bet e ni yen
CH: Best Bet e ni yen, b’o se wa ni yen
CH: Best Bet e ni yen, best bet e ni yen
CH: Best Bet e ni yen, b’o se je ni yen

I come stand for road; me and did dog we dey look our self
Di dog come show him teeth, big long teeth
I come begin dey shake, so tay fear catch me
I come think for my head, say

Dis dog na mad dog CH: e go bite me
my yanga no go pay CH: e go bite me (Repeat)
Wetin I for do? CH: e go bite me
Wetin I for do? CH: e go bite me

I move to left for one corner CH: di dog follow me
I move to the right, another corner CH: di dog follow me
With my agbada, I fall for poto poto CH: di dog follow me
With my new shoe, I enter gutter CH: di dog follow me
Which kind mad dog be dis? Ah-ah! CH: di dog follow me
Which kind craze dog be this? Haba! CH: di dog follow me
Which kind mad dog be dis? Ah-ah! CH: di dog follow me
Ok…so

Oyinbo man talk, he say dog na man’s best friend (X2)
Just like soldier, just like police, just like government
Defender of the country, protector of the poor man
Which kind government be dat
Which kind soldier be dat
Which kind police be dat
Wey just dey harass my life
I not fit waka for road for night

I get to run I no for pose I no for shakara I must to hala
CH: I get to run I no for pose I no for shakara I must to hala (x10)
I say come see fine boy like me wey dey run for road
Bicos of government, bicos of soldier, bicos of police, bicos of army
Ko b’oju mu rara, oro agbedo
I say how fine boy like me go dey run around
Bicos of no light, bicos of NEPA, bicos of no fuel, bicos of no bread
I say come see fine boy like me wey dey run for road
Bicos of government, bicos of soldier, bicos of police, I say I say I say I say
CH: I get to run
CH: Best Bet e ni yen (M’aja m’aja) CH: Best Bet e ni yen (Dog catcher)
CH: Best Bet e ni yen (M’aja m’aja o CH: B’o se wa ni yen( Dog catcher)
CH: Best Bet e ni yen, best bet e ni yen
CH: Best Bet e ni yen, b’o se je ni yen (Repeat till fadeout)

I say help me call di dog catcher
To catch the government, to catch the soldier, to catch the police, to catch the army

I dey run be dat, I don dey run be dat, I no dey wait again o
Tabi make I wait? If you wan make I wait….

© Dele Sosimi & Femi Elias 2005